Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Topic OP
Reasons why we still no dey use E-naira after 2yrs of introduction
by
KupaCrypto
on 08/04/2024, 10:43:06 UTC
E don tey wey dem introduce enaira for Nigeria, but as we dey look am now, why enaira no dey work?
Why Nigerians No Dey Use eNaira?
No misunderstand, Nigerians  Na crypto enthusiasts meaning say them like crypto well well.
Even though Central Bank of Nigeria bin ban crypto activities for banking sector some time ago, but dem don lift the ban. One crypto platform talk say over 33.4 million Nigerians dey trade or hold crypto assets. The question be say
Why country wey dey love crypto well well just decide to abandon their own digital currency?
According to research I make the following factors follow make E-naira for Nigeria unsuccessfull

1. When CBN ban Crypto
Wen Central Bank of Nigeria (CBN) stop banks from dey allow payments wey get to do with crypto for February 2021, Nigerian crypto users see am as attack against dem.
Later wey dem bring eNaira, e be like say dem dey compete with crypto, so e make crypto lovers feel say dem no suppose dey use am; E be like say na psychology matter for my mind.
If CBN bin involve these crypto people for the eNaira plan, e for fit make crypto popular pass and plenty Nigerians for don dey use am.

2. CBN no want Partnership
For dem to do eNaira on their own dey bad idea because CBN na regulator, e no be institution wey dey face consumers.

3. Internet Access
The requirement for wallet to use smartphone and internet dey hard, but think about the people wey you dey try send money to; dem fit dey very poor,  without a good smart phone or even some villages wey network no dey reach

4. We no trust government again
Since then get the mind bind crypto and related activities investors wey supposed invest for the E-naira no come trust the credibility of this government as some see am say the politicians no want make young people get money pass them through crypto. Because even that time Davido been announce say em go buy Bitcoin.

My people for this matter abeg make we add our opinions.