Ona good day ooo. Sometimes I dey wonder waiting this world or this country for look like if crypto been no dey because the rate of hardship in this country is too much and waiting dey cause some of this hardship na selfishness and man know man which most people call tribalism. Imagine where pesin go commot go look for work pesin wey dey in charge go tell you say no vacancy or chance for you mean while there is vacancy and you are qualified for the task but because you are not from same place with them, they will deprived you of the opportunity. Now, those vacancy, chance or slot they use to buy it and the people wey dey buy am na the big men, so times dey go buy slot keep for pesin wey no dey qualify for the job or dey go buy am keep for pesin wey never graduate from school. All these things dey very annoying, in fact e dey discouraging but I go advice everyone to keep pushing one day e go turn around for your good. However, crypto don make so many people no to get interest for all those company work because you fit dey your house dey make your cool money, nobody dey stress you, nobody to disturb you, you fit sleep anytime you want and wake up continue your work, you decide if you go work or not. Crypto is really helping, I get friends for school wey no get parents and right from our first year in school they have being paying their fees with the help of crypto, crypto has given a lot of skilled and unskilled individual hope or reason to survive. Crypto is really sweet and amazing because those salary wey company dey pay worker month end in crypto you fit make the money 1 or 2hrs depending na so crypto sweet reach.