Your point therefore is make people no dey dey hasty in what dey do and make dem still put little effort to try to be sure of wetin dem want do regards to wetin dem hear from hearsay, assume or believe. E make sense.
Sure to confirm things first before acting go really safe person some face, same, apologies because wants you don go act wrongly or take decision wey you no suppose to take because of hearsay wey you never confirm or in your word reinvalidate, omo e fit go cause calamity and na apologies go remain and no be everybody fit just go dey apologize. For some people mind, apology no dey their dictionary, so why make yourself vulnerable to regrets.
Again, e better make we dey hear from both sides before we go take side, very important. This particular one don put people into trouble especially where couples dey involved, husbands and wives suppose to confirm with each other wetin somebody else do before dem go begin act. Like especially some men no dey confirm wetin their wife tell them against a particular neighbor and them go begin carry face or fight the neighbor.
The koko be say we suppose dey put effort to confirm our information before taking decision. We suppose dey patient for certain things and if we get doubt then we can delay the thing and truth go come out. Like for financial matter now, if you delay a scammer, he will not succeed because dem go only catch you if you dey in a haste to collect from them by responding and following what they are saying.