Never put yourself down that you are not good enough for anything.
Na the full stop be this my brother and e no be for only this forum self, na for every part of human endeavour. I don see person wey no go school but dey write pass people wey get degree. So na only an individual fit tell himself say him no good for anything but once you believe in yourself Omo the sky self no fit be your limit.
E get banks wey no study banking courses but at the end dem adjust into am. For school, some student on their own no even be average learners but of lower than average but at the end dem dey beat even best brains for their class just because dem dey give time to their study, stay library like say tomorrow no dey because dem get target.