D way things dey increase for dis contri surprise me well well, e get so many things wey we no suppose mention say na becos dollar don increase nai make.
Make I use this housing as the matter for ground, how piple dey take find house to rent but dem no see the one wey fit their pocket moni abi we go say dollar nai cos that one too? House rent don increase and before you go get house for this contri with this current situation e go hard.
So I dy ask if na becos of say dollar don increase nai make landlords and landladies get mind to increase everything wey concern their house; house rent don go high, agent fee don high, agreement fee don high lawyer fee self don add moni, no be say everything dy the house of toilet fit no make sense and other things wey no good dy the house, wey you fit pay up to 300k...
I dy ask nah Dollar cos this one too bcos plenty piple dy homeless becos them no fit afford wetin house owners dem dy call as price.
Wetin be the main reason for this particular one?
The matter don tired everybody, we no understand where we are heading to at all. We know say dollar price dey affect everything for this naija but no be the way everyone dey put the matter for head, any small thing everybody dey increase the price of their goods, you no fit buy something today and expect to see am buy at the same price tomorrow. You forget say na small opportunity everybody dey look for now to make money, you even dey talk about house rent, but i don't know how dollar price take affect the water wey we dey drink. When dey started subsidy matter common pure no get money reach like this, but as dollar come join am we start to dey see different shege.
Since we started to dey complain about dollar price, the price has reduced to 1000 naira now, did you see any changes for your side. No be today dollar price started to dey come down and nothing gree reduce for this country. The matter go touch everybody even though you dey earn in dollar the products we are buying too dey expensive. People wey dey shout that time say try dey earn in dollar don finally calm.
