D way things dey increase for dis contri surprise me well well, e get so many things wey we no suppose mention say na becos dollar don increase nai make.
Make I use this housing as the matter for ground, how piple dey take find house to rent but dem no see the one wey fit their pocket moni abi we go say dollar nai cos that one too? House rent don increase and before you go get house for this contri with this current situation e go hard.
So I dy ask if na becos of say dollar don increase nai make landlords and landladies get mind to increase everything wey concern their house; house rent don go high, agent fee don high, agreement fee don high lawyer fee self don add moni, no be say everything dy the house of toilet fit no make sense and other things wey no good dy the house, wey you fit pay up to 300k...
I dy ask nah Dollar cos this one too bcos plenty piple dy homeless becos them no fit afford wetin house owners dem dy call as price.
Wetin be the main reason for this particular one?
Any time wey be say we Dey talk about thiings wey Dey rise we suppose remember say na Naija we Dey, in Nigeria both living non living things price Dey rise, nothing wey dollar no Dey affect for Naija, even electricity for Naija dollar Dey affect because if you look at light for Naija this days he no Dey too stay, I don’t know for your area but for my area even electricity don matter don tired us, and about the house rent my brother, house rent suppose rise up too because building material price too get money, even cement now to buy am no be joke.
But the price of dollar Dey decrease everyday and i no see any changes for up to now , na the matter sef Dey pain me pass, dollar price don decrease to the extent wey be say many people wey buy dollar keep now Dey regret but things no still come down, that thing don already Dey Nigeria body, because nothing in Nigeria that the price go up and later come down that even the poor people can afford it.