Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Merits 1 from 1 user
Re: Is Dollar The Cause?
by
Sexylizzy2813
on 10/04/2024, 23:19:18 UTC
⭐ Merited by uchegod-21 (1)
Is Dollar The Cause?
As you use pidgin create this topic, you for also try make the title to be pidgin. Something like this for make more sense. Na dollar cause am?

Person wey give you Uche really know why, you deserve that name my broda, hurry hurry make me post am, I think say all don set but nothing spoil... You do well make the pigin continue dy go to make our local board come back to life.



Quote
But that one na by the way. To chuk mouth for the matter you raise, Nigeria na country where everybody dey do wetin dem like. Some people dey abuse opportunities we surface and many other people wicked. Some landlords wey don build house more than 10yrs ago don break even for the house (as in dem don collect money tire), but still dem high rent price anyhow. I no actually blame people wey build recently because price of things done high high for market. Nigerians too dey take small advantage to suffocate their fellow Nigerians.

No be lie you talk dia, wen I talk say nah we dy use our hand take punish ourselves in side moto one man say na lie say nah Bola Tinubu, I just laf so for dis matter who be this landlord dem?  no be same piple wey dy for dis our contri? Dem dy feel say as long as e no dy affect dem say wetin dem dy do na better thing, how human being go say make him fellow human being dy suffer after dem go blame government.
Landlord dem no know say ones oil touch one finger e go touch d rest, if the house na old house and them wan renovate am no problem to high d rent fee but if the house dy in good condition I see no reason why dem go increase the rent say nah Dollar, wetin concern Dollar for this matter? 95% of the problem we dy face now for dis contri no be dollar cos am na we just wan act like say we wise. I pray make any of una no make mistake offend una landlord oh if not na quick notice.