Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Merits 1 from 1 user
Re: Is Dollar The Cause?
by
MorganaX
on 11/04/2024, 02:42:02 UTC
⭐ Merited by fillippone (1)
D way things dey increase for dis contri surprise me well well, e get so many things wey we no suppose mention say na becos dollar don increase nai make.

Make I use this housing as the matter for ground, how piple dey take find house to rent but dem no see the one wey fit their pocket moni abi we go say dollar nai cos that one too? House rent don increase and before you go get house for this contri with this current situation e go hard.
So I dy ask if na becos of say dollar don increase nai make landlords and landladies get mind to increase everything wey concern their house; house rent don go high, agent fee don high, agreement fee don high lawyer fee self don add moni, no be say everything dy the house of toilet fit no make sense and other things wey no good dy the house, wey you fit pay up to 300k...
I dy ask nah Dollar cos this one too bcos plenty piple dy homeless becos them no fit afford wetin house owners dem dy call as price.

Wetin be the main reason for this particular one?

I no know if you noticed say ever since dollar start to rise everything start to increase. Transportation, feeding now are really hard to afford. Now let’s go to the housing problem some landlords or landladies I no really know if na dollar make the rent increase. You go see old self contain and they go con tell you say na 350k for one kind self contain wey no fit the amount them dey call for me I dey feel say when some tenants enter some houses them dey make the house nice and very fine so them dey pack from the house based on say the house now don dey alright the landlord go con dey increase the rent