Good day my country people, when I newly enter this forum I been dey find am am difficult to write properly in English as English no be our first language, dem don even tell me say this place na only for people wey dey fluent for English but I talk say I no go give up because if I give up na me still lose. I still never dey fluent but I don see some newbies wey I pass but they still manage to do their thing with their heads up high so who am I not to do the same, I have seen that the more the I post and navigate the forum the more perfect my writing skills as practice makes perfect. In essence the message I dey try pass be say, if you want to be good at something you have to keep doing it regardless of how many times you have failed while doing it or regardless of the criticism you have gotten from friends. Never put yourself down that you are not good enough for anything.
Op I understand you clearly, normally writing na skill, no be wattin person fit just wake up one morning start to dey do fluently, except say na gift wey you get. Normally when I first start this forum I prefer to write for pigin pass the English because i been fit dey express myself fluently pass when I use English, but as you talk, practice makes perfect, now I fit use English express myself well. When we dey talk about writing you fit good to dey write long articles and news, but when it comes to this field of cryptocurrency you fit no do well, I'm talking from experience because the kind of words wey you dey come jam, na word wey no dey your vocabulary before so you gats learn first before you fit blend well. I no dey talk about just making one random news post, I mean a good quality post.