Na writing we Dey take communicate here and that be for English and in as much as much as you be learned Nigerian, to write for we English no for be your wahala. Though English no be our first language, na still our first language. In any formal something way you Dey try run, na English you go still use. You no need practice am, although, you need go school well to write well and dey observant to learn from people way get better writing style or format.
Still, the language we dey speak here na Bitcoin and cryptocurrency. Na this one I for say, e no be watin you go just dey sabi like English language. Na watin you gats dey hear, see (on screen) and interact with else, e no go enter body. Na here the practice dey lead to perfection because, you no fit perfect finish. Watin I go end am with be say, make una dey try, na through trier you go escape failure.