Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: When last did you drank to stupol
by
Kelward
on 12/04/2024, 13:04:58 UTC

Share your own experience or thought about this.

Infact e don tey wey I hear last say person drink to stupo, for dis our economy wey be say na food matter everybody de hustle now, as food items money de increase everyday, including beer and hot drink money, everybody don learn to de drink responsibly by force. Some people na for party dem de get di opportunity to de consume excessive alcohol, based on say na free drinks, but now most party na one person one bottle, weda na alcohol or soft drink, di economy no give room for excessive drinking again. Besides di harsh economic situation of di country wey force many heavy alcohol consumers to limit dem intake, e de important to drink responsibly, make we know our guege and respect our selves not to overdrink and embarrass our families, including health harzards of too much alcohol consumption.