• timing the market: This one done really affect many people, way be say them no dey fit hold investment or wait for the right time to invest. This matter way I dey talk so , done make some people sell some kind assets way them suppose hold for maturity too early, and also make some people go buy too early, so make we just allow the market do em thing, because these big moves way we dey find , to be honest, e dey take time.
This one wey you dey talk na wetin dem dey call selling early and I don't know if we go also call am as mistake but for me I no go regard am as mistake oo because at least the person wey sell at a price higher than the price wey him buy the coin don also make profit no matter how much profit wey him make so long as him get ROI from the buying price. So therefore, if you sell early for me no be mistake. It means either the person get need for money or the person dey feel say price go drop for correction and so dem want sell collect the initial profit and then look for another DCA. I don see person wey don dey lucky to dey accumulate coins base on DCA . But if person sell and make profit, that one no be mistake even say him sell early and the purpose fit be for DCA but if him no see lower price to enter again, e no still mean say na mistake but the person no maximize him profit.