Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: HOW ILLITERACY AFFECT BITCOIN INVESTMENT/DISCUSSION
by
Spaceman1000$
on 12/04/2024, 16:32:39 UTC
My people e just come to my notice say unemployment for don reduce for naija if many people were educated and informed about Bitcoin. There is a saying that Education is the key to success. But people wey no go school dey See who go school  as a waste of time and effort because of hard economy. And tag it "school na scam".

School no be scam. Who no go school don  scam himself ful time. I dey always talk am say the  C.E.O of Facebook (Mack zugarberg) for don rich pass as e dey now if many people been go school.

E dey always hungry many people to join bitcoin discussion or BTC investment and many other online businesses. But e no easy. If you check the rate of illiteracy for my country naija you go see say e plenty.

So wetting ona go fit talk for this kind thing my people? Or wetting b the way forward.
The situation for we country dey affect both the educated and uneducated, why e be like that be say, government over the years never really create budget way dey people oriented, why go touch the lives of people. See if available of jobs dey, ego dey for people way go school and people way no go school, sometimes them dey call am, skilled and non-skilled labor. However the reason why people see say school na scam, na because say even after schooling a lot of graduates still find it extremely difficult to secure a well paying job, perhaps most of them just dey manage the jobs way dey under pay them( a high category of graduates fall under am), which to an extent discourages those that are still yet to go or make them see it in a bad light.

Schooling is basically a formal way of learning, which equips you with intellectual knowledge, and shouldn't be seen as any other thing.