Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Time waits for nobody.
by
Makus
on 12/04/2024, 18:27:21 UTC
One fact about rich people be say Dem no dey like lazy people. That's why some people no ft get help from there uncle or friend. when dey see you Dem go dey hide because them no say na beg you wan come beg them. But if you dey hardworking, Dem go like to come close to you because They no say you no go beg them again.

Them say birds of a feather flock together. Wattin some of those people rich na because of their hard work and them no go like make you just come dey beg as if na their hand naim your parent born you put, but when you sef show sign of seriousness for life e go still make others give you that respect wey you deserve. Though some rich persons just wicked normally, na why them say a giver is different from a rich man. One thing I like about my life naim be say I no like make person come dey see me as liability, but rather make a be valuable asset for your life. Na why even outside this forum I dey do all it takes to make sure say I make am for life.