Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Crypto is really helping
by
CryptopreneurBrainboss
on 12/04/2024, 19:51:10 UTC
Ona good day ooo. Sometimes I dey wonder waiting this world or this country for look like if crypto been no dey because the rate of hardship in this country is too much and waiting dey cause some of this hardship na selfishness and man know man which most people call tribalism. Imagine where pesin go commot go look for work pesin wey dey in charge go tell you say no vacancy or chance for you mean while there is vacancy and you are qualified for the task but because you are not from same place with them, they will deprived you of the opportunity.

Although I get where you dey come from but sometimes when dey say vacancy no dey but you still see people dey get job there dem no lie, there are some slots only reserved for people from a particular region. Whether we like am or not, reservation of slots will always be a thing in this country because even our ogas at the top dey run am. Most political position na reservation dem dey run am and na to carry everybody along be the main reason why dem dey do am. We get plenty zone for the country so some slots need dey reserve for some particular people to carry everybody along make e no belike only a few selected groups they benefit from the whole thing. When a company comes into your village, dem go reserve slot give village people so their youths fit get job.

Quote
However, crypto don make so many people no to get interest for all those company work because you fit dey your house dey make your cool money, nobody dey stress you, nobody to disturb you, you fit sleep anytime you want and wake up continue your work, you decide if you go work or not. Crypto is really helping, I get friends for school wey no get parents and right from our first year in school they have being paying their fees with the help of crypto, crypto has given a lot of skilled and unskilled individual hope or reason to survive.

I no go tell anybody to leave their job and focus only on cryptocurrency investments, as the name implies this is suppose to be an investment and not a day to day job money making opportunities for you so you suppose get regular job wey you dey run as you dey take the money wey you dey make from there to invest for the industry. If you fit do like this you fit comot mind when you dun buy Bitcoin and keep hodling but when you dey get both your daily bread and capital gain from the market e go hard for you to fit become a hodler. Opportunity full the industry but if you wan do am make sure say na worked you dey find so and no be say you wan dey make money from your coin purchases dey use feed regularly.