My brothers and sisters for this kajad cabal I greet una and happy new year to all of us. I say make I table this matter for here and if say person don discuss this mata, my apologies as I no see any of such nature before I bring this one up.
Wetin make me dey ask this question nah say after observation, I discover how some newbies wey register here, after them don drop some posts and e happen say one of the posts receive backlash, you go see say gradually, that user go start to dey scarce for here and before you know e go twy before you see them.
So I wan know from us, wetin we feel say be the reason wey dem dey lose interest like that? Abi nah say some no fit stand criticism or here too hard or wetin? Abeg make we discuss.
I see am dat way too oo I know say me I be newbie too but I know weytin I find come here so I go get am, because me wen I first enter this forum I dun get orientation of how this matter be but some of all this newbie them think say e just deh quick to achieve something,not knowing say u go follow steps by step procedure,some go say them no get that kind time to deh type,do this and that for this caban.
Me I take am say e no make sense at all because anything weh u wan achieve for life nah Patience follow am,and u know say people go criticise you as u wan achieve something but u go know where u deh go so that u know go miss ur way.and another thing weh deh make them loose interest be say their mind no deh for the thing.