My people e just come to my notice say unemployment for don reduce for naija if many people were educated and informed about Bitcoin. There is a saying that Education is the key to success. But people wey no go school dey See who go school as a waste of time and effort because of hard economy. And tag it "school na scam".
School no be scam. Who no go school don scam himself ful time. I dey always talk am say the C.E.O of Facebook (Mack zugarberg) for don rich pass as e dey now if many people been go school.
E dey always hungry many people to join bitcoin discussion or BTC investment and many other online businesses. But e no easy. If you check the rate of illiteracy for my country naija you go see say e plenty.
So wetting ona go fit talk for this kind thing my people? Or wetting b the way forward.
You dey correct at some point.
Although we no go fit overemphasize the importance of formal education but whether you agree with me or not, I'll always say that not everyone are meant to go to school and acquire that formal education. If you check the country very well for our country today. Illiteracy is not the major cause of poverty in the country but Ignorance, mediocrity and Laziness.
You fit dey uneducated but you dey informed and industrious, and with those qualities you fit get opportunities to make am big. Do you think it's all successful people that are educated or had access to formal education?
That's why I dey always comot cap for our Igbo brothers. After secondary school, if Igbo man see say en pikin head no carry book, e go jejely ask am which trade e go wan learn. And if that pikin dey serious for that trade, e go make am through there without acquisition of formal education.
Don't get me wrong, I'm not saying education or being educated isn't good, No, all I'm saying is that it's an overhyped means of becoming rich, they make it look like after graduation from school, there's a well paying job lying around and waiting for you, yet we have so many unemployed graduates, some even came out top in their classes but yet no job.
The system for Naija no be the same for the Western world so make we dey try call spade spade and shovel shovel.