Good day my country people, when I newly enter this forum I been dey find am am difficult to write properly in English as English no be our first language, dem don even tell me say this place na only for people wey dey fluent for English but I talk say I no go give up because if I give up na me still lose. I still never dey fluent but I don see some newbies wey I pass but they still manage to do their thing with their heads up high so who am I not to do the same, I have seen that the more the I post and navigate the forum the more perfect my writing skills as practice makes perfect. In essence the message I dey try pass be say, if you want to be good at something you have to keep doing it regardless of how many times you have failed while doing it or regardless of the criticism you have gotten from friends. Never put yourself down that you are not good enough for anything.
True true, I no go lie for u, to work for this forum no be come chop o, e hard wetin no nice but nevertheless we still dey push am dey go and na so we dey learn dey go too, although before wen I still join this forum new new, I been dey think say if person wey no go university no go fit dey inside this forum, na person tell me say na lie, as far as person sabi read and write, say the person fit blend in, na so I say mk I try luck and as I dey inside the forum, dey post everyday, na so I no dey find am too difficult again and na so I come dey know how to reply, quote, put my English them in order unlike before so in this life, anything wey person dey bring am dey do am, even if e dey very difficult but as u dey do am steady na so u go dey see am say e don dey easy to do and u go dey even dey enjoy am join.