Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Merits 2 from 1 user
Re: Practice makes perfect
by
Stable090
on 14/04/2024, 16:36:09 UTC
⭐ Merited by Antotena (2)
Good day my country people, when I newly enter this forum I been dey find am am difficult to write properly in English as English no be our first language, dem don even tell me say this place na only for people wey dey fluent for English but I talk say I no go give up because if I give up na me still lose.
D person wey tell you say na fluent English dem dey speak for here just dey whine you, actually I no talk say make you no sabi English, but e no dey necessary say make e be fluent English, as long as people fit read and understand Wetin you dey write then no wahala. This place na forum, and na people from different part of d world dey here, which we know say English no be everybody first language, so no be everybody go fit speak fluent English.

And even if you no too understand English like that, local board dey, atleast you go fit communicate for your own local language, like dis our board board now, if you no dey fit speak English well, then you go fit speak pigin, and if u no understand pigin like that, then English dey for you, so you see say the thing dey easy.

Wetin I dey tell people be say Make you no dey underestimate yourself say you no fit do something, as long as people dey do am, if you self calm down put head, you self go do am.