Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Merits 2 from 1 user
Re: Don't panic just hodl
by
Stable090
on 14/04/2024, 19:46:32 UTC
⭐ Merited by Nheer (2)
Well yesterday Bitcoin literally experience some dip , and I was excited ( because I see it has an opportunity to get myself some good quantities) while some individuals was out there selling their holdings, due to the dip which initiated some panicking. But I won't blame them though , because most people are just new in this space without any solid knowledge on how things work here , so due to that at any slight dip they would quickly sell with the fear that the dip may continue.
That yesterday dip pain me because I no get money buy more coin, I just dey look as everywhere dey red, but e no bad Sha, another dip go come I go dey prepare keep for that one. How you go buy coin, then after dip you will decide to sell? You don dey at lost already you no suppose sell now, na hold you suppose hold am. For crypto make you know say time go come wey coins go come down, and if you fit hold am e go still go up, so nobody suppose dey panic if coin dump now. I know say e no easy make you dey check your wallet make you see say you dey at lose, but if you get patience e go bounce back.

If you be investor, you suppose dey keep money separate for dis kin dip, incase if dip happen any moment, you go fit buy more add to the one wey dey your wallet already, dip na opportunity to accumulate more at a very cheaper price. If coin dump, some people go dey fear to buy because dem go dey reason say e go dump more, but make we know say we no fit see coin at the lowest price. Na why some people dey take miss opportunity.