Wetin be the main reason for this particular one?
Na inflation problem no be dollar. The government go try put hand take draw the price of fuel down. Na the price of transportation wey go make commodities wey dey for local consumption go down. Even when importers carry market come like building materials, custom dey charge no be small plus other costs wey you go run for corrupt offices before dem go gree release your market no be small money. To clear 40ft container now I hear say na around 14/15 million and so naturally dem go add am inside the products wey dem go sell. So before we go begin feel the impact of the current reduced exchange rate, the government go put hand for petroleum products and na that one go drop transportation cost wey local people go know and feel before dem too go drop price.