Make I use this housing as the matter for ground, how piple dey take find house to rent but dem no see the one wey fit their pocket moni abi we go say dollar nai cos that one too? House rent don increase and before you go get house for this contri with this current situation e go hard.
House matta pass dollars own but make you know say dollars dey affect everything for the country because we dey use dollars import fuel and na fuel dey control our movement through transportation and the rest. Dollar dey affect all our importation and the things wey we dey use build houses are mostly imported so dollars dey affect house but apart from the house na agents follow for this high costs of house. Make we first talk about landlords dem wey no dey Nigeria and dem dey hand over the house give house management companies, dem go come add their own price and plenty charges so dem for fit chop and the the landlord wey dey the country come dey see wetin people dey willing to pay for the other houses go come increase their own and from their houses around that area go come dey cost carelessly.
Yahoo boys/fraudsters follow too because those one dey rush house like water and dey willing to pay any amount which also motivate the other landlord to increase their own house rent to fit cash out too.
I dy ask nah Dollar cos this one too bcos plenty piple dy homeless becos them no fit afford wetin house owners dem dy call as price.
We no dey homeless here oh, go America or other Western world and you go see wetin dem dey call homeless. House cost everywhere normally, e get people wey dey pay our yearly fee as monthly house rent like for American, Europe so no too complain but I dey understand because the house rent matters just come from no where and na agents we go blame mostly for that one because when we been just dey meet the landlord directly, house no been cost like this but since agents done enter na so everything begin they increase.