Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Don't panic just hodl
by
I_Anime
on 20/04/2024, 12:40:58 UTC
Person selling no mean say person lose, some people dey for massive profits wey be say dem fit sell their Bitcoin anytime and e no concern them how the market be. They dey sell no mean say dem no get solid excuse to sell as many reasons fit dey why dem dey sell. Maybe dem dey sell so dem fit get faits incase anything happen for front wey go make market to dip well well. See ehh the market no just get a particular pattern again like that, anything fit sup anytime so e good make we dey hold fiats as we dey hodl Bitcoin too so we no go enter problem wey go make us to go dey sell our Bitcoin to bail ourselves. So make we no dey reason people wey dey sell because na dem know wetin dey make them sell because without a reasonable excuse no be person suppose tell you to dey hodl as bear market dun end so.
Your point is on track boss and you're right, many people expecially those ones wey dun tey for Bitcoin accumulation and their holdings go fit dey take profit as dey like because dem dun go far with Their own accummulation of Bitcoin. And keeping fiat as emergency funds still nice , we nor fit just dey hold say we nor get any fiat for hand , because as humans expenses must dey ground wey e go require some funds to solve or handle am even both expected an unexpected expenses. And having some good fiat go help person fit hodl bitcoin without much stress or without relying on their Bitcoin investment whenever any financial situation sup.

Na this one shock me pass but I been dey expect am because alot of good things happen to Bitcoin wey supposed make am dun blow pass like this self. Imagine if the approval been happen during the bull market, the price of Bitcoin for don touch better price since. After this bull run e go hard to make money like that from Bitcoin so make we use am as an opportunity to do our best to fit make money from the market before Bitcoin gets so popular wey be say e no go too dey get better price movement to fit benefit from. Make we no use hodling play, e no get any coin wey you wan invest inside wey go give you full confidence like when you invest inside Bitcoin. The advice our brother dey give although na very popular advice but make we no use am play.


This one dey very true , e get certain point wey Bitcoin go reach ehnn to afford Better quantities go dey hard and to make good profit go still dey hard because person nor go fit dey gather better quantities for himself to fit yield Better thing from there holding whenever there's any increase in price. Because at that time Bitcoin value nor go be person mate again ohhh and at that time e go dun get mad adoption. So the right thing to do now is to grab this opportunity wey dey ground so ( this bull run wey dey come so ) by stashing better quantities for their portfolio. That why many people dey pray wey dip sup before bitcoin skyrocket for the bull run so that dem go fit ready well with better Bitcoin stash for their portfolio.