Of recent I say make I try plant okro around my house ...I come realize say some of the okro no gree grow while others don pick up ..wetin I do I still replant again...and I no only replant but I also water them now I come see say them sef don dey grow and I come dey get joy as them dey do well.
Wetin I dey try talk, make we know say as we dey invest at first e fit no yield result but e no mean say profit no go come ,,we just need consistency even as we wan enter a new year...I believe say na year wey get positive vibes especially for bitcoin
We all know say farm work no be for the faint hearted likewise to invest too but in all with God our expectations will come through 🙌
Na true talk and I totally agree with u, investment no be really the way we dey think or mk I put am like this, investment no dey easy the way we think say e dey, e just be like farm work like u talk, sometimes u go do well, sometimes u no go do well, for example like me, wen I never really understand crypto well, I think na just to put money buy coin dey watch am as e dey grow immediately den withdraw my profit comot but I got it wrong because I no check the market well before buying any coin, na just like that all my money just go o, I no make profits even my capital I no see, na after some months wen my mind no dey der again, na the coin come rise, I make better profits that time o, so even if I never get all the ideas about crypto but at least I understand say Bitcoin investment or crypto investment na just about Patience, e fit be short or long term investment just like the way we dey farm, when we plants things in our farms like cassava, yam, okro, corn, we already know say na okro and corn we dey first harvest before cassava but no be just immediately, e take time na so investment dey too, na e mk dem dey always dey draw us hand for ear say mk we first understand wetin we won sign up for, if we just fall today and e go take like moths or years to rise back. But most importantly be say mk we get patience and self control, this two na e they conquer investment.