Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Investment be like farm work
by
Cityhunter34
on 22/04/2024, 15:45:04 UTC
Of recent I say make I try plant okro around my house ...I come realize say some of the okro no gree grow while others don pick up ..wetin I do I still replant again...and I no only replant but I also water them now I come see say them sef don dey grow and I come dey get joy as them dey do well.
Wetin I dey try talk, make we know say as we dey invest at first e fit no yield result but e no mean say  profit no go come ,,we just need consistency even as we wan enter a new year...I believe say na year wey get positive vibes especially for bitcoin
We all know say farm work no be for the faint hearted likewise to invest too but in all with God our expectations will come through 🙌
Op na true you they talk because e dey always dey good to have foursite and invest on a genue thing so that tomorrow you go smile with the thing wey you invest, however investing in Bitcoin only sometimes isn't really good because as na long time investment person suppose get small small things wey go dey fetch out money like @peter faith mentioned farm investment dey really help like garri, na weting dey sustain some many now when dey harvest am them go sell am before you no person don gather small money take start up business be that oh.