Don't attack me, but for me is Garri. It literally blend with any kind of soup (egusi, ogbono, oha, afang etc, it can go along side with bean. I fit soak am with or without sugar 😁.
Make I first welcome you to the forum, especially for dis our local board, as a naija person, you enter for di best place to learn and increase your crypto knowledge, so that in di nearest future you sef go sabi and help newbies wey go join in di future to grow dem knowledge. Having said dat, I want you to understand say dis your thread na off topic for dis our board, e no follow for di kind topics wey we need, our ogas for dis forum don make am clear say we no want people wey go de spam our local board with topics wey no concern cryptocurrency and relevant news.
Unto say you be newbie and you never get experience of di kind of topics wey we need, so na advice I give you so, make you take note say dis kind of your topic no follow at all, and to lock dis thread for make sense, so dat dis your new account no go get coma.
On a lighter note as e concern dis your topic, garri be di survival food for our masses.