Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Government demanding from Binance the lists of its Nigerian users
by
HajiBagi
on 23/04/2024, 09:49:30 UTC
FG detains two Binance executives –Report

Two senior executives of Binance were allegedly to have been detained by the federal government. The executive officers flew to Nigeria after Binance website was taken down by the NCC in a way Nigeria can not be able to access the website. Although, the site is still accessible through the mobile app.

The federal government are demanding to see a list of Binance Nigerian users since the exchange inception, a person familiar with the matter said.

Waiting federal government want, waiting them wan use am do if not be thief wey federal government be, me with my own hard earned money na e one stupid federal government go Dey disturb my life, Binance no go even try do that rubbish with them na, because even if them get the list na steal them go steal people money, but I Dey wonder ooh, what is the meaning of this, this thing start from the day wey I see dollar enter 1900 naira and the federal government say make them no allow Nigeria use Binance again, say na because of dollar na E make things price high for the country, see our government na big criminal and by god grace them no go see waiting them want.

The most painful part be say upon all this thing wey happen, nothing change for the country, the price of things are getting high everyday, I don talk am before say if things price rise for Nigeria it will never go down, and look at it now, E even better make dollar no come down because I no see why dollar come down and nothing change, person just Dey see different shege banza for Naija everyday.