My people, I greet una. Few weeks ago when dollar was 1900, things were very expensive, now wey dollar be 1540 shey things suppose come down? Abeg anything come down for una side? Abi nothing da come down for Nigeria? This matter don tire me. Went to the market yesterday and I actually expected things to reduce due to dollar little stability, but reverse is the case. Seems this country is getting worse. How una see am?
My dear, for this our Naija, once price of something don go up, e no fit come down again, if e like make dollar reduce to 500, as dey price don dey e done dey, nothing go change am rather dem go just leave am der, and people go dey buy, Nigerians don dey use to buy things even at costly price, we go dey murmur o but we go still dey buy so e don master people, so dem go dey do as dem like, say beside people go just murmur and dem go still buy so make the price dey der mk I gain small too, which is not good, tell me why Naija no go dey dey worse when corruption still dey exist.