Every body wan make quick quick Cash .Gone are the days when youths work hard to earn a living,them no send how the money take come..nai make now scammers full everywhere...nobody is safe . Government too is to be blamed Sha cuz if you go all these government offices no workers yet they won't employ fresh graduates .Na only God go help us
Na true u talk o but now no be youths again o, na children now dey find money and dey want mk money quick quick, children wey supposed still dey school, now be say na because say work no dey, because they still supposed dey school or go learn any skill but dem no ready to go school or go learn work, wen u tell dem, dey go say that time to go school or learn don pass while some go say dem no fit do am, that is to go work or learn work, like this now we no go blame the government again because all those children never even reach to take care of themselves or abi they get family wey dem dey feed? No but na corruption wey just dey this our country, small children don dey involve themselves into money ritual just to dey live big man life, make them dey buy cars, build houses etc, this one wey dey happen now, I no go blame the government or blame some of their parents, na just say them don dey corrupt and na only God go fit save us.