For me oh, I think say Bitcoin na blessing to us, because no single entity get control over Bitcoin.
Making it more resistance to censorship and manipulation.
E dey empower individual to get direct control over their finances without relying on intermediaries.
Yes u dey correct, Bitcoin na really blessings to us, especially for me o because ever since I know Bitcoin my life don change, I don advance for life , if no be Bitcoin, o for no know wetin I know today, Bitcoin don really create jobs for plenty people and I thank God say Bitcoin no dey under government power, if not by now, e for don crash and people for they suffer more, since government dem dey enjoy to dey see us suffer but Bitcoin don come to help us out yet, dem still won comot Bitcoin from existence which can't be possible, because if no be Bitcoin some people for no get kind idea wey dey get today about Blockchain and Bitcoin don help to the extent, some people na land owners while some na business people, etc.