Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Quick money wahala
by
rachael9385
on 24/04/2024, 21:41:17 UTC
This na the kind of things wey don come see inside the society,  the bad thing be say as e don be like this the worse of it will continue to happen because the government have not tried any of their best to put an end of the way people are getting into this illegal stuff to get money. The government does not have the capacity of stopping this guys because they haven't done the necessary thing they are suppose to do. I will always fault the government for what is going on right now.

Indeed, we expect more from the government to do their own part why they were elected in. Assuming  say dem no too dey greedy, say dem invest for our refineries by now the unemployment rate for done reduce well well, and we for no get too much graduates Dem wey dey unemployed. Another thing to consider na the kind of course wey some persons dey go study for school. I don hear of many person wey apply to study one course then after Dem don get admission the school come give dem another course to study. Some of them from civil engineering to agriculture. Abeg wattin person wan use agriculture do? Your chances of getting employed dey very low. Courses like that, recruiting companies sef recommend experience pass result.
Nah true you talk but as a matter of fact e no dey good to depend on government jobs these for these present economy wahala wey we all dey face so. Nah because of all this things nai make e good say person get hand work (skills) wey em learn because as you finish school government job no dey make the person just use that one take support em sef till the day wen better ones go come. E get one slangs wey I believe in like this "make person no settle for less but if you see less, first use am take guide". If you are not guided hunger go finish you, so as a citizen wey know say their government no dey on a trusted side nah for you to just get good skills wey you go use sustain if the raining days come.