Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Is Dollar The Cause?
by
Ever-young
on 25/04/2024, 07:39:50 UTC
D way things dey increase for dis contri surprise me well well, e get so many things wey we no suppose mention say na becos dollar don increase nai make.

Make I use this housing as the matter for ground, how piple dey take find house to rent but dem no see the one wey fit their pocket moni abi we go say dollar nai cos that one too? House rent don increase and before you go get house for this contri with this current situation e go hard.
So I dy ask if na becos of say dollar don increase nai make landlords and landladies get mind to increase everything wey concern their house; house rent don go high, agent fee don high, agreement fee don high lawyer fee self don add moni, no be say everything dy the house of toilet fit no make sense and other things wey no good dy the house, wey you fit pay up to 300k...
I dy ask nah Dollar cos this one too bcos plenty piple dy homeless becos them no fit afford wetin house owners dem dy call as price.

Wetin be the main reason for this particular one?

Dollar no be the cause of anything wey dey happen for this country, anything wey dey happen for this country na we and the government dey do am, just imagine how things dey cause now, meanwhile dollar don come down well well o, yet the price of things still dey high, we just dey add price for things we dey sell just to take advantage of people knowing fully well say na suffer dem dey suffer us, even the government them self, to create job opportunities self na war, even some people wey still dey work office work or dey work for government, to pay them dem better salary na still big wahala for them, with all this how dollar be the cause rather for me I see dollar as the solution to the our current economic pressure self, because assuming say dollar dey high and things dey cost like this, person like me no go too reason am self, we dey country where God don bless yet we dey just dey suffer ourselves dey blame dollar.