Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Merits 1 from 1 user
Re: What makes cost of living still high in Nigeria when dollars loose value.
by
Samlucky O
on 26/04/2024, 15:39:05 UTC
⭐ Merited by hugeblack (1)
A trader that bought goods when dollars was at ₦1800 and now dollars dey ₦1200 you no go expect am to dey sell at the rate of ₦1200 because na at a lost him dey sell so and there's no guarantee say after him sell finish say dollars go stay stable for am to restock him goods. Dollars self fit go rise to ₦1500 or more. If dollar rise him dun lose in two ways and if he continues like that he'll run out of funds and also out of business.
In addition to wetting you dey talk, I see am say why cost of living still high even as dollar to Naira dey drop, na because of the citizen. Why I say na citizens na because every thing we dey produce for this country sopos cheap since na locally made product wey we no dey import. But the citizens chose to sell their products high and dem go put the blame on dollar to naira. Emagine garri sellers from the rural areas wey been dey sell garri for cheap price don increase am say dollar to naira don rise so garri go cost. Every other sector for the economy dey capitalise on naira to dollar even when dollar don come down E no concern dem. People forget say na lowering the price of good and rendering of low service Naim dey control inflation and deflation, when people decide to bring down price of their products down E go make sence. Another problem be say no unity among citizens. If Mr a decide say his goods price go come down, Mr B fit decide say him own no go sell equally like Mr A. So if government go fit bring price regulation control team to dey regulate price starting from petrol and other production sector like agriculture and so on, you go see say price go come down by force and if price don come down E go gradually stablize dollar to Naira.