Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Is Dollar The Cause?
by
MarissaLopez
on 26/04/2024, 21:55:01 UTC
D way things dey increase for dis contri surprise me well well, e get so many things wey we no suppose mention say na becos dollar don increase nai make.

Make I use this housing as the matter for ground, how piple dey take find house to rent but dem no see the one wey fit their pocket moni abi we go say dollar nai cos that one too? House rent don increase and before you go get house for this contri with this current situation e go hard.
So I dy ask if na becos of say dollar don increase nai make landlords and landladies get mind to increase everything wey concern their house; house rent don go high, agent fee don high, agreement fee don high lawyer fee self don add moni, no be say everything dy the house of toilet fit no make sense and other things wey no good dy the house, wey you fit pay up to 300k...
I dy ask nah Dollar cos this one too bcos plenty piple dy homeless becos them no fit afford wetin house owners dem dy call as price.

Wetin be the main reason for this particular one?

 I greet una oo..Abeg I deh new for here but I wan tell una my own opinion
This issue taya me as e taya anybody for here,d way things deh go yo these days and then go say nah because of dollars I know just know why.
The food aspect nah worst pass,u enter market today, tomorrow go dat same market everything dun increase and the price dun change just like that,and when u go ask one reasonable person,dem go say dollars dun increase oo nah why the price of things kuku increase but I come deh do rough check with myself how this kind thing take deh possible but I get to understand one thing,weh be say transportation nai be one Koko weh deh cause this thing but most people know wan see am like that.

The area weh I deh if I tell u the price of fuel,and dem know get much filling station weh get fuel like that,now as  e be so how do people,market men and women wan take market their goods or do business..so nah why d increase dey come from no be dollar anything.
And another thing I believe be say our money bo too get value again over dollars so nah why wen the dollars deh increase e deh worry our naira  deh make am deh depreciate as e be fiat money,so this one go urge us to put ourind for crypto currency Wella cause nah dat one be the way for now.
Nah so I see this thing oo