This fuel subsidy dun be wahala for this country and e dun make a lot of things deh cost for market and people deh wonder how deh wan use tackle am.but I hear say good news deh as dangote refinery dun start to produce oil and fuel dem and even port Harcourt refinery sef,dem dun deh start to produce which go fit make things better small and I believe say d price go fit deh fix for now.
But the thing weh come deh paine be say,the area weh I deh now, I know know oo weda weytin deh happen no touch dem the thing just deh give me concern since,weh I hear say port Harcourt go sell 500 per liter but for here the price of fuel deh increase like say dem deh fetch water full drum and the thing deh affect many things for here,inside this week all the filling station close down since morning,nobody open like this,say dem get quanta like that, Omo that day ehn e woski for everybody,as people no fit see bike or vehicle go where dem dey go.. meanwhile people come deh go the nearest state to buy black market sell.the thing pain me well cause I Trek ehnn go where I deh go.so later that day nah for evening dem come Open to sell,weh deh sell per liter for 740 like this..and like this ehn e go increase transportation for here jaga today nah e dun reach 780 I wonder weytin person go do abi nah only here this fuel thing deh skyrock.
So I wan know how much dem deh sell fuel for your area abi nah just here deh sell this kind thing..
Make we relate abeg.