Yes some how I agree with them because a lot is going wrong in the country
This is Nigeria were you see animals eat money, Nigeria is a place people do a lot of things bad roads and corruption has taking all over, but still on still as the matter be we all still dey believe on change of the country, come wetin u think?? u don ever think am
Omo ehn, I gree with wetin u dey talk o but leave am o, Nigeria sweet to dey o, if no be as things be like this, Nigeria na one of the country wey cruise full, even as we dey complain like this but at least we still dey console ourselves by making ourselves happy and we dey dey somehow alright with that, so for me, I no think say to be a Nigerian na mistake o, because I never see any country wey dey as free as this country, and wey dey handworking reach this country, na just our leaders dey make our handwork no dey show working, if no be the way Nigerians be, tell me why oyibo people dey fear Nigerians, omo leave am, this country dey better and na we go still dey make am more better and okay for our own benefits, mk we no dey wait for our government to first make a move before we go make like say dem be God.