Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Merits 2 from 2 users
Re: Don't keep your hope in any news of bitcoin
by
Kelward
on 01/05/2024, 15:56:27 UTC
⭐ Merited by Charles-Tim (1) ,Igebotz (1)
Di crypto market de volatile, dat na why we no fit to say Bitcoin price must be dis or dat in di future, na only speculations we fit to do, and every experienced Bitcoin holder suppose know say na so e be. Aldo events wey concern di world like wars, finance and oda breaking news fit to affect di price, also whales fit to dump dem Bitcoin to manipulate price, but in all na demand and supply de determine im price.

I realize say after di halving, many newbies de expect say Bitcoin price go begin to surge and we go enter bull run immediately, but di reality now be say price de dip di more everyday, and some of dem panic and de rush to sale dem Bitcoin, but di truth be say research don show say bull run no de start immediately after halving. Any investor wey de hudl Bitcoin no suppose to de focus on di short term pump and dump price speculations, because na long term project im suppose be.