Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Merits 1 from 1 user
Re: 3 things to know before investing in Bitcoin
by
CryptopreneurBrainboss
on 08/05/2024, 06:36:38 UTC
⭐ Merited by Igebotz (1)
THE HALVING AND BITCOIN MINING: 3 THINGS TO KNOW BEFORE INVESTING IN THIS EXPLOSIVE INDUSTRY.

Without clicking on any link I go also drop my own three things wey you need to consider before investing into Bitcoin, everybody fit get their own things to consider based on the knowledge wey dem get so there's no technically three things but it's based on who is giving you the information. Make we dey also know say some of this website dey find click bait wey dey go use bring you to their site and some of their advice no be anything technical but just general knowledge wey everybody supposed know so without going any further, here's my own three things to consider before investing into Bitcoin.

  • • Bitcoin no be ponzi scheme wey you go dey expect to get rich quick or expect a specific return of investment after you dun invest inside am finish. Some ponzi business and high risk investments website dey use Bitcoin as their payment option but e no mean say na so Bitcoin be so make you no dey confuse the two of them.
  • • investing in Bitcoin for long term (instead of the narrative of short term investment or trading) go benefit you pass. Buy Bitcoin and hodl better pass anything else wey anybody dey tell you. If you try am you go see say e dey stress free and highly profitable. Ask any OG for the Industry and dem go tell you this truth.
  • Non constodial wallets are better wallets than constodial ones wey be centralized wallets. The ideology dey say centralized wallets better pass since you no go dey incharge of keeping your coins safe but that one na lie, this industry revolves around putting the security of your finances into your hands so if you go dey commot that power from your hands to another third party, e go backfire one day and you go lose your Bitcoin

Things plenty to talk wey a first time Bitcoin buyer supposed know but since we dey limit am to three things for this thread, this na the three wey me I dey see say we support dey aware of before we buy our first Bitcoin so we no go dey expect another thing come dey feel disappointed.