But one I know for sure be say even if government try succeed to block NGN p2p trading on all angles, Naija boys go always find a way out even if eh go cost us more fees.
If dem delist trading in Naira on every centralized exchange wey dey available to us, then we go either begin trade in decentralized exchanges or we go begin use local vendors, the thing be say using local vendors dey very risky and vendor wey you trust today, fit carry your money run tomorrow. As e be now, we still get a few centralized exchanges wey we go fit use, and make we hope say things won't get worse than it already is.