Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Avoid these crypto investment mistakes
by
Jegileman
on 08/05/2024, 22:05:46 UTC
•un-diversified portfolio:  this one just dey like putting all your eggs in 😂 one basket. Which means say anything way sup for that basket go affect all your eggs. So make we try to spread our investment across other reasonable assets.  then another major investment mistake na

Wetin you mean by other reasonable assets? Hope say no be diversification in other crypto assets you mean by that? Dis wan no go be better advise if na wetin you mean be dat because market no go play your way if na wetin you wan venture your money into only. Diversifying of portfolio fit come through investing in other assets out of the crypto world that are reliable and trustworthy. E no mean say na only crypto you go depend on to make you rich or achieve your targeted investment. Your major mistake in dis aspect na him be say make you put money for any coin wey you come across and hoping say dem go do you well after some time. If no be bitcoin, just know say you dey gamble with your money and wetin you expect fit no be wetin you go take your eyes see.