My country people, wonder sha never end. Finally we all suppose don find out say every treat from our today government na due to greed and selfishness. So recently our government demand 150 million dollars from oga kpata kpata for binance just to make the illegal Nigerian charges go away.
I don hear about this with my guy and i never see the news like this say make I confirm am but normally that thing no be new thing for Nigeria na, our government don’t know anything na to just create way to chop money wey no be their own, our government no know anything than money and that is why the country matter Dey always get worst every day, I don Dey talk am say all this para wey the government Dey do no go reach anywhere na just another to make money from all this online exchanges and use the money settle their self and shop their life.
From the first time that I knew that they were just para for nothing is that they have started doing this is not for today and anything wey government wan ban for Nigeria no dey work, na eyes them sabi open so that they go use the opportunity make money, and if you look that habit e don Dey everybody body wey Dey Nigeria because even our parents sometimes them go para say them no go give you food chop when you offend them and at the end na them go call you say make you come chop the food

, our government no get mind to ban Binance and all this cryptocurrency exchange’s because them too get dollar wey them Dey hold for their wallet.