You guys have spoken well. Please for the pros here through more lights or update on the ones you feel is legit to invest in
You fit consider BSCpad if you like but DYOR on it so that you go take your decision by yourself. The price don really drop now unlike last month. So it is one of the coin wey go do well this season from my own believe. Icenetwork too fit try. This one na new list and dem fit ride with the hype of the market for this season being say na new project wey be like say dem mean business. So DYOR before you take your decision.
We go de grind till the end, na life be that. It's very important to become one of the very best set of traders and investors for the space. The rewards and regards wey go follow go too choke. Everybody de on their own for the space and e for better say make person first DYOR for project before actually placing trades and investments. The space no be carry come, and the way dem designed am ehn, person wey no gree lay down sabi the important basis for the space go lose back to back.