Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Merits 4 from 2 users
Re: If we had higher magnitude of Crypto adoptors and Literates in our society.
by
Cryptoprincess101
on 15/05/2024, 22:14:51 UTC
⭐ Merited by Fiasem20 (3) ,fillippone (1)
Lets go decentralized, make we abandon anything wey get to do with centralized because the governments can always come after them. If no be Binance wey stand strong by now the government for dun get details of people wey dey trade from the exchange but dem no fit do that one with decentralized exchange and wallets. If you no dey use non custodial wallets today start now before it's too late because after the governments succeed for this one wey dem dey do, dem fit do another one just to crack down on cryptocurrency entirely.

Saying let's go decentralized like how wey we go fit achieve decentralized exchange platform because the system fit dey porous unto say e no go involve KYC so people no go too reason am and talking about non custodial wallets, na person wey chop belle full na in dey hodl or keep yin Crypto for non custodial wallets no be say I dey discourage people wey dey use non custodial wallets but you reason am na e no dey easy for people in the country at all to come dey tell person say make him dey hold coin for non custodial wallets.

In other hand too wetin you dey yarn na the koko be dat because anyhow e be people go still survive so e better say you get hope for somewhere so e go good to just dey accumulate dey go but fear and lack of patience na another thing wey dey worry us for dis country because any small tin na so our body go dey shake.

Is there a measure to conquer this government with our decisions over cryptocurrencies?
Having higher crypto adopters or not no body dey fit challenge government o no matter who you be so even if we have people wey plenty wey get the eye of cryptocurrency well well for we country e no go fit change anything so make we just relax because nothing wey we go fit do.