Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Merits 13 from 5 users
Topic OP
🍕 Bitcoin Pizza Day on Bitcointalk
by
SatoPrincess
on 17/05/2024, 19:28:06 UTC
⭐ Merited by Igebotz (5) ,GazetaBitcoin (3) ,klarki (2) ,LoyceV (2) ,Porfirii (1)
Quote from: Voting for the Best Pizza [Soon]Last year's [Results]Bitcointalk Party [Discord] Prize $250 new [Raffle] 🎁




Every year on the 22 of May nai the bitcoin community dey celebrate bitcoin pizza day. This na the day where e be say one forum user way them dey call Laszlo pay 10,000btc for two Papa John’s pizza (for real life, Laszlo talk say him spend about  50,000 Bitcoins to buy pizza). This contest na better opportunity for you to showcase your cooking skills and join body for the tradition way Bitcoiners dey celebrate with their loved ones with your ogbonge pizza 🍕

  
        Prizes nkor?

Sponsor for this year contest na  BC.Game, BitcoinGirl and Theymos (if anyone won still join this list, make una pm icopress). Nor forget say  Bitcointalk Pizza Day 2024 no be official event, na community event him be. The contest go get 5 winners wey go share prize fund of $2,500 in Bitcoin.

                  
   



🥈 2/3rd place
🥇 1st place
🥉 4/5th place



Prize of $500
Prize of $1000
Prize of $250



                                                                                                                                                                     
      
   
       How e dey be?

From the time when the thread  go drop until June 1st, you get the opportunity to post picture of your pizza (read the rules under). After the marked date, we go open voting thread where we go fit select 5 winners (the voting system go belike the one we use for the Bitcointalk awards).

* Post at least 2 photos: [1] Photo of Pizza + username and date [2] Photo of when you dey make the Pizza  ➥ Note
* Pizza should be Bitcoin pizza (Bitcointalk style is allowed).
* You must use your own hand make the pizza / Only one pizza per user ➥ Note.
* I get the right to decide  whether wetin you bake make sense or not. 

Make I drop small advice ... as person way don dey tidy Bitcoin pizza with my family for the third year in a row, I don settle my mind say e dey  better to add Bitcoin symbols after the pizza don dey inside  oven for 7/10 minutes. If you add BTC symbols right away, them go start to bake heavily tay tay before the pizza go ready.

You dey free to shook mouth for the matter!!