Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Do Airdrop tel buy bitcon
by
Gozie51
on 20/05/2024, 09:21:12 UTC

Also remember the risk wey dey Airdrop, use separate wallet for Airdrop, observe well before you do anyone bcos some na waste of time.

That waste of time na im be the thing wey dey discouraging and you no fit know the one wey go give you that cash out, that is the challenge for airdrops. Some dey stressful to the extent that you will get tired of dem because you go need to do different assignment, move from one wallet to the other which may be tiring and at the end that project fit no enter market, dem go just carry presale money waka.

Anyway, the thing about airdrops be say you no know the one wey you go take cash out on. Like dem dey talk for proverb say nobody sabi the womb wey go born king and that is why there is no harm in trying but e dey difficult to determine good project make I no lie.

Yes people don cash out better money from notcoin and ice as I hear say some too before dem this year. That notcoin be like it will do well as e get things and things with ton, e dey inside ton ecosystem.