Also remember the risk wey dey Airdrop, use separate wallet for Airdrop, observe well before you do anyone bcos some na waste of time.
Na d koko be dat. I don mention dis same thing about using different wallets/burner for airdrops. Creating wallets nor dey take pass 3 to 5 minutes. So, make we nor go dey think sey e dey take time. Again, make we dey always make sure to back owa wallet apps and write out owa seedphrases somewhere safe.
About d airdrop thing, ICE fall many people hands, including me. Na just NOT wey bring back owa morale by making us smile to d bank. We nor know which other ones go pay us, not even Tapswap. Airdrop na game of chance. NOTcoin pay me too.