Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Do Airdrop tel buy bitcon
by
Stable090
on 21/05/2024, 20:25:39 UTC
For here we don already know why e good to invest in bitcon already but bcos of economy matter, we nor fit invest in bitcon as we want but thank God Airdrop and bounties don dey pay well again. We don see people wey dey cash out welll from them well well especially from the latest one wey be Not  coin, people cash out well from m and other recent one like Ice and the others.
Now wey bull run self Dey come, any opportunity wey anybody get make him use am accumulate more bitcoin. Recently I notice say Airdrop and mining Dey pay well recently, even we never Dey bounty season yet, but any money wey anybody make from all dis mining and Airdrop make dem use am well. E better make you invest in bitcoin, and if you are the type wey be say you better to put money for alt coins, then e go better make you leave money for better alt coins ooo. No go buy meme coin wey be say e go don crash self before bull run start.

My advice be say make we nor dull put for Airdrop matter, do m wen the money come buy bitcon, nor go dey HODL Airdrop coins bcos most times the developers na to make money na concern them and so once the coin don dey listed they go sell wey them still cash out.
Even as I Dey signature wey I still Dey use small money accumulate bitcoin, I no go lie I still Dey Tap tap tap, e fit funny ooo but for dis country now any legit way to make money make person put head Dey do am ooo country hard now and things no really funny.

But Wetin you talk Dey true, no Dey hold Airdrop or mining coins, if Dey just pay, make sure say you swap your thing make you commot your money ooo.

Also remember the risk wey dey Airdrop, use separate wallet for Airdrop, observe well before you do anyone bcos some na waste of time.
E no make sense say you go use your main wallet for Airdrop now, some of those Airdrop and mining na scam them be, immediately you connect your wallet to them, they will have access to your wallet, and Dey go fit move everything wey Dey your wallet. But if na new wallet you use, even if na Scam and Dey get access to your wallet, nothing Dey d wallet wey dem go move now.