Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Do Airdrop tel buy bitcon
by
Cryptomultiplier
on 22/05/2024, 07:14:07 UTC
For here we don already know why e good to invest in bitcon already but bcos of economy matter, we nor fit invest in bitcon as we want but thank God Airdrop and bounties don dey pay well again. We don see people wey dey cash out welll from them well well especially from the latest one wey be Not  coin, people cash out well from m and other recent one like Ice and the others.

My advice be say make we nor dull put for Airdrop matter, do m wen the money come buy bitcon, nor go dey HODL Airdrop coins bcos most times the developers na to make money na concern them and so once the coin don dey listed they go sell wey them still cash out. Just take your cash out tel invest in bitcon so that go fit quickly reach your accumilation goal.

Also remember the risk wey dey Airdrop, use separate wallet for Airdrop, observe well before you do anyone bcos some na waste of time.
Notcoin and other bounties in telegram dey hot right now as you don state because I also learn about the airdrops wey dey pay quicker than BTC investment or trading.
One other thing na to take note say the market no dey as stable as BTC market be for HODLing long term or even short term. Person wey wan HoDL airdrop go need to HoDL for very short time because the market fit tip and such coins go just dwindle to finish.

No follow follow sha because person wey you follow do airdrop fit get reserve portfolio to hold side incase airdrop fail. Safe guard your sense and pocket and don't use money you can't afford to lose o.