Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Merits 1 from 1 user
Re: Do Airdrop tel buy bitcon
by
rachael9385
on 23/05/2024, 19:13:04 UTC
⭐ Merited by Makus (1)
For here we don already know why e good to invest in bitcon already but bcos of economy matter, we nor fit invest in bitcon as we want but thank God Airdrop and bounties don dey pay well again. We don see people wey dey cash out welll from them well well especially from the latest one wey be Not  coin, people cash out well from m and other recent one like Ice and the others.

My advice be say make we nor dull put for Airdrop matter, do m wen the money come buy bitcon, nor go dey HODL Airdrop coins bcos most times the developers na to make money na concern them and so once the coin don dey listed they go sell wey them still cash out. Just take your cash out tel invest in bitcon so that go fit quickly reach your accumilation goal.

Also remember the risk wey dey Airdrop, use separate wallet for Airdrop, observe well before you do anyone bcos some na waste of time.
Hmm... You dey sure say as this one you dey refer to pay another one go pay? Economy or not we still get people for naija wey still dey invest for Bitcoin, the matter be say if you no get money make you no invest because the economy no dey stable again and as we country dey so, the cost of living done almost kill the living finish sef.
Anything airdrop matter, dey very risky, you fit take much time dey claim and and make you no dey surprise say at las nah ponzi schemes.