My advice be say make we nor dull put for Airdrop matter, do m wen the money come buy bitcon, nor go dey HODL Airdrop coins bcos most times the developers na to make money na concern them and so once the coin don dey listed they go sell wey them still cash out. Just take your cash out tel invest in bitcon so that go fit quickly reach your accumilation goal.
Op no be lie na true tok be that because after when di exchange list di airdrop for some.time.or years when dem see say the airdrop no fit meet up dem go delist am again so the best way na to collect everything as dem list am for the exchange and use the money invest in bitcoin to increase the wallet quantity. Omen na sweet tok be dis oh. And di one way dey onboard now na di tapping master. And I come.hear say na this coming week nai dey go launched am for exchanges but I doubt because if to say dem go launched am we for dey hear am everywhere as Notcoin been dey.
Then another one wey dem dey mine na Hamster Kombat, himself dey good to mine now. And those who missed the mining of the Notcoin nai dey mine anything wey come to the crypto world.